You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Ichthyosis: 'Pipo dey avoid me becos of my skin'
Published
Onyinye na 28 years old model wey dey live wit lamellar ichthyosis, a skin condition wia pesin dey live wit dry, cracked and scaly skin.
For interview wit BBC Pidgin, she say she don experience a lot of down side sake of her skin but she don overcome di mentality.
Di model say she no dey bothered about wetin pipo dey tink about her anymore.
She wan make pipo wey dey like her realise say dem no dey different from oda pipo.
Maduka Lynda Onyinye say her plan na to start a non-governmental organization for pipo wey dey live wit lamellar ichthyosis to help dem gain confidence and become wetin dem wan be.