You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
How Lagos, Abuja dey observe relaxation of coronavirus lockdown
Published
As pipo for Lagos State, southwest Nigeria and di kontri capital, Abuja, don dey commot small small sake of di relaxed lockdown, e be like say many don forget wetin social distancing mean.
Nigeria President Muhammadu Buhari announce say from today, 4th May, pipo for Lagos, Ogun and Abuja fit commot go do dia work between di time of 8am and 8pm.
Di goment say di measure dey necessary to allow make pipo wey dey live on daily money to fit work and survive as world dey battle coronavirus.