You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Port Harcourt Hotel Killing: Police gbab man wey wan strangle one woman wit towel
Police say dem don arrest anoda suspect for one hotel inside Port Harcourt wia di man wan strangle one woman wit towel.
Tori be say since July, at least eight deadi bodi of young ladies wey pesin strangle na im dem don see inside different hotel rooms for di Southern, Nigerian city.
Commissioner of Police for Rivers State Mustapha Dandaura tell women wey dey protest di serial killings for Port Harcourt on Wednesday say dem arrest di man early morning of September 18, 2019.
CP Dandaura say di woman raise alarm for Nsirim Hotel for Rumuokoro area of Port Harcourt wey attract pipo attention, so dem call police come go break di room door open.
Na dia dem catch di man wey bin wan strangle di woman with towel, di Police oga add.
Dis go make am three suspects wey police say dem don arrest concerning di serial killings for hotels for Port Harcourt for Southern Nigeria.
Di Commissioner of Police say im don personally question di man wey dey dia hand and dem don shut down di hotel wia di incident happen.
Di women wey bin do demonstration on Tuesday dey demand for more action from di authorities to protect women and stop di killings.