England maintain dia perfect start to qualification for Euro 2024 as first half goals from Harry Kane and Bukayo Saka help dem defeat Ukraine 2-0 for Wembley.
Di Three Lions bin no start well and bin rely on di brilliance of Saka to take hold of di match.
Saka produce fine cross down di right for Kane wey jab im cross into di net on 37 minutes.
Kane wey become England all time top scorer on Thursday wit 54 goals stretch di record even further wit im effort tonight.
Before Ukraine go know wetin dey happun, England stretch dia lead three minutes later through Saka.
Di Arsenal wideman curl im shot beautifully into di top corner afta im receive di ball from Henderson.
England boss much of di second half and Ukraine get dia goalkeeper Trubin to tank as im ensure say di scoreline remain di same.
Im first save from Gallagher late into di game before im deny Maguire deep into injury time.
Victory see England record dia second group win in four days as dem dey top of Group C wit maximum points from two matches.