#EdoDecides2024: How Edo governorship election take waka

Ova 2.2 million pipo register to vote for who go be di next govnor of Edo State for southern Nigeria.

Summary

  • Vote counting don start for Edo state governorship election
  • Heavy security mount for INEC collation centre
  • Olumide Akpata lose for im polling unit
  • Afrobeats star Davido dey para for INEC
  • Whoever become govnor-elect go replace Godwin Obaseki for office on 11 November

Live Coverage

Helen Oyibo, Annette Arotiba, Victor Ezeama

  1. Breaking, Labour Party candidate Olumide Akpata don cast im vote

    Labour Party govnorship candidate for di Edo state gubernatorial election, Olumide Akpata don cast im vote.

    Akpata cast im vote for polling unit 011, ward 06 New Benin, Oredo LGA.

    Labour Party govnorship candidate Olumide Akpata  afta e cast im vote
  2. Police arrest suspected political thugs, recover weapons

    Fotos of locally fabricated guns

    Wia dis foto come from, NIGERIA POLICE FORCE/X

    Di Nigeria Police Force don arrest two political thugs wey dem say dey plan to cause kasala during di Edo state govnorship election wey dey hold on Saturday, 21 September.

    Dem arrest di suspects from Ugbobo quarters, Igara Akoko, Edo state on di eve of di election.

    Police say dem recover local gun and three cut to six locally fabricated pistols from dem and add say di suspects currently dey for dia custody and go face di full weight of di law.

  3. EU dey observe Edo state gubernatorial election

    European Union election delegation team dey for Edo state to observe di governorship election

    Wia dis foto come from, EUROPEAN UNION/X

    Di European Union (EU) election delegation dey for Edo state to observe di ongoing gubernatorial election.

    Di EU for dia X account tok say through dia EU support to democratic governance in Nigeria (EU-SDGN), dem don establish two situation rooms for di state – one on gender and di oda one on persons wit disabilities.

  4. Breaking, APC candidate Monday Okpebholo cast im vote

    APC candidate for di 2024 Edo State Govnorship election, Monday Okpebholo don cast im vote.

  5. Breaking, Inec give update on X

    Di Independent National Electoral Commission, Inec, don confam say accreditation and voting begin exactly 8:30am for Polling Unit 005, Registration Ward 05, Idumebo primary school, Esan Central Local Government Area.

    Accreditation and voting commenced at 8:30am today at Polling Unit 002, Registration Area 2, Iguobazuwa, Ovia South East Local Government Area.

    Inec bin say accreditation and voting go begin at 8:30am and close at 2:30pm, provided say all voters wey bin already dey queue by 2:30pm go dey allowed to accredit and vote.

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  6. 'I dey excited to vote'

    Osagiege Sunday

    53 years old Sunday Osagiede na pesin wey dey live wit disability.

    E say im don dey vote for over 20 years now and e dey excited to vote today too.

    Inec say over 2.2 million voters dey eligible to cast dia vote.

    Osagiede go vote for ward 12 polling unit 3.

  7. Accreditation of voters don start for some polling units

    Electoral officials dey prepare ahead of di election
    Wetin we call dis foto, Electoral officials dey prepare ahead of di election

    For Benin City, di Edo state capital, di Independent National Electoral Commission (Inec) officials don begin accreditation for voters for di Edo state govnorship election..

    Accreditation officially begin by 8:30am.

    Early voters dey check dia names for dia polling units
    Wetin we call dis foto, Early voters dey check dia names for dia polling units
    Inec ad-hoc dey wait for vehicle to take to take dem to dia polling unit
    Wetin we call dis foto, Inec ad-hoc dey wait for vehicle to take to take dem to dia polling unit
  8. Breaking, Accreditation of voters begin

    Accreditation of voters don officially begin for di Edo state govnorship election.

  9. Lady chop punishment for disobeying restriction order

    Security operatives for Edo state punish one woman on top accuse say she disobey electoral rules.

    Edo state governorship election dey hold today Saturday, 21 September 2024 and di Inspector-General of Police Kayode Egbetokun bin on Friday order restriction of movement for di state ahead of di governorship poll from 6:00am to 6:00pm.

    One lady dey kneel down
    One armed security man and one lady kneel down
  10. 'Na three horse race'

    Collage foto of Asue Ighodalo, Olumide Akpata and Peter Okpebholo
    Wetin we call dis foto, Kontri pipo focus na majorly on only three parties, di Peoples Democratic Party (PDP), All Progressives Congress (APC) and di Labour Party (LP) and dia candidates.

    Di campaign for di number one seat for di state dey hot as 17 political parties dey eye di seat. However, kontri pipo focus na majorly on only three parties, di Peoples Democratic Party (PDP), All Progressives Congress (APC) and di Labour Party (LP) and dia candidates.

    Before now, na two political parties dey mostly dominate Edo politics, di ruling PDP and di opposition APC, but di upcoming election dey ready to feature fresh candidates, and dis go bring new angle for di state political landscape.

    Also, di 2024 election go dey interesting as e go bring back di rivalry between two former allies Govnor Godwin Obaseki and im predecessor, Adams Oshiomole, wey now be senator and dey represent Edo North senatorial district for di National Assembly under di platform of di APC.

  11. Wen di election go start?

    Voting go start by exactly 8.30 am across di various polling stations for di state, but Inec officials dey expected to don arrive by at least 8:00am to set up for di election.

    Na only pipo wey get di Permanent Voters Card (PVC) go fit vote.

    Wen di voter approach di Inec officials, e go first show im PVC and di Inec pipo go check am wit di Bimodal Voter Accreditation System (BVAS).

    Afta dat, di Inec pesin go also check di name of di voter for di voters register and mark am say e don dey accredited.

    Di voter go den collect di ballot paper and go to di voting cubicle to thumbprint on am bifor e go drop am inside di ballot box.

    Inec officials go also apply ink on di thumb of di voter to show say di pesin don vote true-true.

    Afta voting, di voter fit go house if e want, or e go stay some meters away from di voting area to wait for sorting and counting.

  12. Simple guide to Edo state govnorship election

  13. Security agencies dey ground for Edo election

    Security agencies for Edo governorship election

    Di presence of security heavy across Benin, di Edo state capital for di state governorship election.

    Police, sojas plus oda security operatives dey stationed for various points, dem block all major roads for di early hours of di morning to restrict anyhow movement.

    Di Nigeria Police Force bin announce say dem dey deploy 35,000 officers to provide security for di election.

    Di Inspector General of Police Kayode Egbetokun wey give di informate add say dem dey expect ova 8,000 security personnel from oda agencies to join dem for di election.

    E say dem don ban di Edo State Security Network, so dem no go take participate for di election. Also no private or state-owned security apparatus go dey allowed to operate during and afta di election.

    Di police say dem don deploy drones, helicopters plus oda equipment to foresee any untoward incidents during di poll.

    Tok-tok pesin for di Force, Muyiwa Adejobi say na DIG Frank Mba go lead di police team, and Assistant Inspectors-General and Commissioners of Police go dey posted to senatorial districts and local governments.

    E say dem ready to support Inec to ensure fair and peaceful electoral process for Edo.

    Security agencies for Edo governorship election
    Security agencies for Edo governorship election
    Security agencies for Edo governorship election
  14. 17 contestants dey battle for Edo state top job

    Police officer dey verify party agent.

    On Saturday, September 21, 2024, Edo State pipo go comot go vote for who go take over from Godwin Obaseki as di govnor of di state.

    Di Independent National Electoral Commission (Inec) don tok say dem dey ready for di elections and dem call on residents of di state who dey old enough and who don register to vote, to come out and exercise dia franchise.

    Sixteen men and one woman na im dem dey contest for dis ogbonge position of govnor of Edo State. Even though say na only three of dem wey dia campaign don dey hot.

  15. Una welcome!

    Good morning!

    Una welcome to our live coverage of di Edo state govnorship election.

    Na for here we go dey bring una live updates as e dey happun, wen e dey happun.

    Una welcome and thank you for staying with us.