Police use tear gas chase protesters for Lekki as Nigerians mark 2nd anniversary of #EndSars protest

Youths for 2020 bin carry waka enta streets across di kontri to protest police brutality and call for di scrap of di Special Anti-robbery Squad, aka SARS.

Live Coverage

  1. Why Atiku lead di wave of resignations comot from PDP?

  2. 'Pipo dey call me DJ wey no get hand' - Deejay Bankyroy

  3. 'We dey bury pipo almost everiday now' - man tok afta 27 pipo die for fresh Plateau State attack

  4. Buhari death don create political vacuum for Northern Nigeria?

  5. From military ruler to democrat - ex-Nigeria President Buhari life in pictures

  6. Tinubu pay last respect to Buhari

    Tinubu wave to Buhari bodi

    Wia dis foto come from, Rahma Abdulmajid/Facebook

    Nigeria President, Bola Tinubu pay im last respect to im predecessor Muhammadu Buhari, former president.

    Tinubu bin receive di bodi of late Buhari for Katsina as dem move di bodi for burial for di late president hometown.

    Oga Tinubu in company of im oda goment officials bin dey present as dem lay di bodi of Buhari to di ground.

    E wave to di bodi as sign of respect bifor dem move am to di grave.

    Di president don alreadi order say make all national flags fly at half-mast across di kontri for seven days, from Sunday 13 July to 20 July.

    E also add say di Nigeria goment go give President Buhari full state honours wey befit im full contributions to di kontri, and na wetin happun today.

    For May 2023, Buhari hand-ova to Bola Tinubu as President of Nigeria.

    Dem bury di former president under di islamic rites.

    Tinubu siddown as e watch Buhari bodi

    Wia dis foto come from, Rahma Abdulmajid/Facebook

    Wetin we call dis foto, President Tinubu watch di bodi of late Buhari
    Some men in agbada bin carry di bodi of di late Buhari

    Wia dis foto come from, Rahma Abdulmajid/Facebook

    Wetin we call dis foto, Pipo say prayers for di bodi of Buhari
    Tinubu pay im last respect as dem bury late Muhammadu Buhari

    Wia dis foto come from, Presidency

    Tinubu pay im last respect as dem bury late Muhammadu Buhari

    Wia dis foto come from, Presidency

  7. Tinubu receive former President Muhammadu Buhari body, Sad mood fill di air for Katsina

      • Author, Adesola Ikulajolu
      • Role, BBC News Pidgin
    Military officials bring down Buhari bodi

    Wia dis foto come from, Rahma Abdulmajid/Facebook

    Wetin we call dis foto, Dis na how di military officials bring down di bodi of Buhari from di airplane

    Di bodi of late Nigeria former President Muhammadu Buhari don finally land for Daura wia dem go bury am today.

    Sad mood, black outfits and emotions fill di atmosphere as dem dey comot di bodi of late Buhari.

    Dem bring di bodi of late Buhari down from di airplane wey carry come Katsina.

    As all attention dey for Daura, Katsina State for di burial, di mood of di pipo dey sad as dem dey mourn di death of di former President.

    President Bola Tinubu bin receive di bodi of di late Buhari as military officials bin carry di remains.

    Buhari die on Sunday for one London hospital afta a period of sickness.

    Di 82-year-old bin serve as Nigeria president two times: first as head of state for 1983 and den im win election for 2015.

    Dem go bury di late Buhari according to di Islamic rites, wia pipo go also pay dia respect to am.

    As Nigeria President Tinubu don declare seven days of National mourning, e show say several pipo go attend to pay dia respect to late Buhari.

    A military official looking at di remains of Buhari covered wit Nigeria flag

    Wia dis foto come from, Rahma Abdulmajid/Facebook

    Wetin we call dis foto, President Tinubu touch di remains of late Buhari
    Military officials accompany di bodi of late Buhari wit oda officials by di side

    Wia dis foto come from, Rahma Abdulmajid/Facebook

    Wetin we call dis foto, First Lady Oluremi Tinubu pay her respect to di late Buhari
    Military officials gada holding a casket wit Nigeria flag

    Wia dis foto come from, Abdulaziz Abdulaziz

    Wetin we call dis foto, Dis na how dem carry di bodi of late Buhari to wia dem wan bury am
    Military officials gada holding a casket wit Nigeria flag wit airplane for background

    Wia dis foto come from, Abdulaziz Abdulaziz

    Wetin we call dis foto, President Tinubu accompany bodi of late uhari to wia dem go bury am
  8. Former Nigeria VP Atiku arrive Daura for Buhari burial, El-Rufai and odas land Katsina to pay dia respect

    Atiku wit oda officials

    Wia dis foto come from, Atiku Abubakar/X

    Former Vice President of Nigeria, Atiku Abubakar don show for Daura, Katsina State.

    Atiku arrive for Daura for Tuesday afternoon wia e go attend di internment.

    "I just arrive for Daura for di interment of former President Muhammadu Buhari," e write for im X.

    Atiku arrive in entourage of Nasir El-Rufai wey dem gada recently form coalition.

    Who be Atiku?

    Atiku na former Vice President of Nigeria from 1999 to 2007.

    E get Master in international relations from Anglia Ruskin University, UK.

    E be former customs officer wey come into politics for early 1980s.

    Atiku contest to be president of Nigeria for 1993, 2007, 2011, 2015 and 2019,but e no wokr out.

    Atiku na one of di major PDP members wey pull out dat time to form di New-PDP and later enta di APC just bifor di 2015 general election, but shortly afta dat election, e return to di PDP and na im be di party presidential candidate in 2019 and 2023.

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

    Atiku greet one man wey bend to greet am

    Wia dis foto come from, Atiku Abubakar/X

  9. WATCH: Nigerians react to death of Buhari

    Wetin we call dis Video, Nigerians get mixed feelings about dia former President wey die at age 82.

    From e time as military leader, to wen e serve as democratic president, Nigerians get mixed feelings about dia former President wey die at age 82.

    BBC News follow some Nigerians tok for different parts of di kontri to get dia reactions on di death of former Nigeria President.

    "E fit get pipo wey enjoy from am, but I bin no benefit from am."

    Dis na wetin one Nigerian bin tok wen e dey react to di death of Buhari.

    Anoda one tok say Buhari na ogbonge leader to am and dem go miss am.

  10. 'I belong to nobody, my wife belong to di oda room' - Some popular quotes of Buhari wen e bin dey office

  11. Meet 70, 80-year-olds wey dey run car wash for Enugu

  12. Former Nigerian President Buhari begin final journey home

  13. Overstay fit lead to deportation and life ban – US Embassy warn

  14. Goment declare public holiday ahead of former President Buhari burial on Tuesday

  15. How Nigerian woman smuggle baby into UK wit fake birth story

  16. Nigeria draw wit Algeria and finish top of group

  17. Former Nigeria president, Muhammadu Buhari die at 82

  18. Life and times of former Nigerian leader Muhammadu Buhari wey die age 82

  19. Wetin be di health benefits of sweet potato

  20. Why Trump wan deport migrants to Nigeria plus oda third kontris - and if e do am?