Inec suspend announcement of Kogi State Govnorship results until Monday

Latest results from Bayelsa and Kogi Govnorship elections wey Independent National Electoral Commission announce dey inside hia.

Live Coverage

Daniel Semeniworima and Onyinye Chime

  1. Bayelsa State governor Seriake Dickson don cast im vote for Toru Orua, Sagbama LGA

    Seriake Dickson cast im vote for Sagbama

    Wia dis foto come from, Bayelsa State Government House Press

  2. Former Nigeria presido Goodluck Jonathan say voting for im ward start late

    Former Nigeria president Goodluck Jonathan no dey happy say voting for im ward start late.

    Oga Jonathan wey also bin serve as govnor for Bayelsa State from 2005 to 2007 say as of 8:19am wey e reach im ward to vote nobody bin dey ground.

    Im say as Nigerians "we no suppose to do tins anyhow and expect di best."

    Im add say make pipo for Bayelsa and Kogi ensure say di elections go peacefully as dem no go fit conduct elections for crisis situation if dem really want good leaders.

    Wetin we call dis Video, Former Nigeria president no happy say voting start late for im ward
  3. Kasala don burst for Dino Melaye polling unit

    Dem don shoot one pesin afta katakata start for Senator Dino Melaye polling unit.

    Less than one hour afta e comot from di voting unit, some jaguda pipo for two Hilux vans and Honda Civic storm di place begin shoot for air.

  4. Inec suspend election for Ologi community for Bayelsa

    Supervising Electoral Officer for Ogbia LGA, Nkwachukwu Orji say, even though di election dey generally peaceful for di LGA, place like Ologi community bin get katakata.

    For Ologi community, area pipo bin no wan do election so dem pack all do materials wey dem suppose send go some polling unit burn dem.

    dem don suspend election for di community.

    Nkwachukwu Orji
    Wetin we call dis foto, Supervising Electoral Officer for Ogbia LGA, Nkwachukwu Orji say INEC suspend election for di community
  5. Oga Jonathan no happy say election start late for im ward

  6. Jonathan as e dey cast im vote

    Jonathan as e dey cast im vote
  7. '...having served dem (Kogi pipo) well well, dem go decide to renew my mandate'

  8. Goodluck Jonathan cast im vote

    Afta plenti delay, former presido Goodluck Jonathan cast im vote for Otuoke.

  9. Update for Kogi East election

    Na total lock down for Ayingba, Dekina local goment for Kogi East Senatorial District.

    Afta im cast im vote, Peoples Democratic Party candidate Musa Wada, alledge say di work of APC chief jaguda pesin wey from di area na to snatch ballot box plus chase voters away.

    PDP candidate Musa Wada as in dey cast im vote
  10. Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  11. Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  12. Kogi female candidate Natasha don finally vote

    Natasha don finally vote
    Natasha don finally vote
    Natasha don finally vote
  13. Distribution of materials don begin for Otuoke

    Few minutes past 11am na im materials take reach ward 13 unit 39 for Otuoke, di polling unit of former President Goodluck Jonathan.

    Inec don begin distribute materials for Otuoke
    Inec don begin distribute materials for Otuoke
    Inec don begin distribute materials for Otuoke
    Inec don begin distribute materials for Otuoke

    Wia dis foto come from, BBc

  14. Anoda SDP agent wey dem attack
    Wetin we call dis foto, Anoda SDP agent wey dem attack
  15. one of di agents wunjure for ear
  16. Men wit military uniform attack Obeiba ward 1

    Female candidate Natasha Akpoti say military men attack dem for her polling unit for Code 19, Obeiba Ward 1, Okehi local government.

    Some agents cari wound for head sake of di attack.

    According to her, di suspected military men attack afta pesin wey dem suspect to be APC agent bin wan use one voter card and im no gree, den dem begin beat am.

    Natasha Apoti
  17. Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  18. Dino Melaye don do acreditation

    Dino Melaye don do acreditation
  19. Katakata for Natasha ward

    Katakata don burst for Obeiba ward 1, di ward of di only female govnorshi candidate for Kogi.

    Natasha Akpoti dey fear to comot from her house go her polliing unit.

    SDP agents chop beating and dem kidnap odas for Obeiba ward 1.

    Natasha Apkoti, di only female candidate for Kogi guvnorship election
  20. Update on Bayelsa

    Election don begin for unit 5 ward 8 Imiringi, but materials neva reach all di polling units including Otuoke for Ogbia LGA.

    Materials reach polling units for former Nigeria president Goodluck Ebele Jonathan ward for Otuoke.

    Officials for Otuoke RAC centre say say dem just dey finish to sort di material.

    Election don begin for unit 5 ward 8 Imiringi Ogbia LGA
    Wetin we call dis foto, Election don begin for unit 5 ward 8 Imiringi Ogbia LGA
    Materials neva reach Otuoke
    Wetin we call dis foto, Materials neva reach Otuoke polling units