Wetin you need to know about di intercontinental ballistic missile wey Russia fire enta Ukraine

Published
Read am in 3 mins

Russia don launch one intercontinental ballistic missile during one attack on Ukraine on Thursday, Kyiv air force tok.

Dis na di first time wey Russia dey use powerful weapon wey dem design to deliver nuclear strikes thousands of kilometres away.

Dis launch na di latest sign of say tensions dey increase fast for di 33-month-old war afta Ukraine fire U.S. and British missiles at targets inside Russia dis week despite Moscow warning say dem go see am as major escalation.

BBC no fit to independently confam say na ICBM dem fire for dis latest attack by Russia, but most times wreckage scraps from exploded weapons dey appear online soon afta and from dia e go possible to determine which likely weapons dem use.

Security experts say, if dem confam am, e go be di first time wey any military dey use intercontinental ballistic missile (ICBM) - strategic weapons wey dem design to deliver nuclear warheads.

Ukraine no specify di kain warhead wey di missile carry or which kain missile wey e be. E no get any sign say e bin dey nuclear-armed.

Russia no immediately comment on di Ukraine air force statement.

Wen tori pipo ask about di air force statement, Kremlin tok-tok pesin Dmitry Peskov tell dem to contact di Russian military for comment.

Wetin to know about intercontinental ballistic missiles

Intercontinental Ballistic Missiles (ICBMs) return us to di Cold War between di den-Soviet Union and di Western kontris - wen fear of nuclear war dominate dia military doctrine for most part of di 20th Century.

ICBMs very much remain for arsenals of United States, Russia and a few oda kontris, under one international framework of regulation.

Ukrainska Pravda, one Kyiv-based media outlet, claim say anonymous sources tell dem say di missile na RS-26 Rubezh, one solid-fuelled intercontinental ballistic missile wey fit to travel up to 5,800 km, according to Arms Control Association.

Dem bin first successfully test di RS-26 Rubezh for 2012, and dem estimate be say e dey 12 metres (40 ft) long and weigh 36 tons, according to Centre for Strategic and International Studies (CSIS).

ICBMs na strategic weapons onto say dem design dem to deliver nuclear warheads, but dem also fit fit dem wit conventional explosives too, and e fit travel several thousand kilometres at high speed – wey make am difficult to intercept or stop am.