You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Who be Dorcas Adeyinka, di blogger Nigeria police declare wanted?
One UK based blogger wey di Nigeria Police Force declare wanted in connection wit case of cyber-stalking, abduction and murder case don react.
Na on Sunday, 12 May, Police for Nigeria bin declare Dorcas Adeyinka wanted.
One poster wey di Nigeria Police Force post on dia X account also allege say di blogger also dey wanted in connection to injurious falsehood, threat to life and extortion.
Di poster from di Inspector General of Police (IGP) Monitoring Unit say make anybody wey see her, arrest and carry her go di nearest police station.
"Handsome reward await any pesin(s) wit information leading to her arrest," police tok.
I no go dey intimidated! My humanitarian work dey vex my enemies – Ms Adeyinka tok
Di popular UK blogger and self-acclaimed philanthropist, wey also hold traditional title as di Aare Tayese of Owode-Otta for Ogun state don reply di Nigeria Police declaration.
Ms Adeyinka for Facebook react say “Wen you dey innocent you get nothing to worry about.
Na only me get all dis accusation? We fit do more dan dis for dis earth.
End of Di one wey oda users dey read well well
You don do your research before you announce say you dey find me? I no dey always show up if you invite me?" Ms Adeyinka ask Nigeria police.
She say all dis dey happun because of issue she get wit some pipo on social media.
She add say pipo wey write fake petition against her give police don do worse thing to her on social media, she allege say dem even share details about her private life online.
She say di reason dem dey come afta her na sake of her humanitarian work.
Lawyer for Ms Adeyinka don also dismiss di allegations against her, say she be "law-abiding citizen" wey dem "unfairly target".
Pelumi Olajengbesi, say di allegations boil down to "social media altercation" between Ms Adeyinka and some oda individuals.
E say na Ms Adeyinka bin first report di mata give police, "only to face further harassment and attempts to silence her".
E add say im client no ever "shun" di police and bin don "initiate contact wit di appropriate channels".
Who be Dorcas Adeyinka?
40-year-old Dorcas Adeyinka na Nigerian born British citizen.
According to di profile on her Facebook page, Ms Adeyinka na entrepreneur wey gain popularity through her business. She be social media influencer plus philanthropist.
She dey run one blog called TMS blog.
She come from Ekiti state.
Ms Adeyinka comot Nigeria go UK at di age of 7. She go primary, secondary and University for there and she get degree for Law from di University of East London.