You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Hundreds die afta explosion for Gaza City hospital as America president land Israel
Hundreds of pipo don die afta explosion hit one crowded hospital for Gaza City, health officials tok.
One doctor don condemn di explosion e call "a massacre" wey happun for Al-Ahli Arab Hospital.
Palestinian officials tok say na one Israeli air strike cause di blast.
But di Israeli military tok say di explosion na di result of one failed rocket, Palestinian Islamic Jihad launch - accusation wey di militant group don reject.
Israeli warplanes and artillery don dey bombard Gaza in response to di attack wey di main Palestinian militant group, Hamas, carry out on Israel on 7 October wey kill 1,300 pipo.
Reports say more dan 3,000 pipo don die sake of di strikes on Gaza.
Di hospital blast dey affect efforts to solve di humanitarian crisis for di city, plus Jordan don cancel one planned summit wy suppose happun on Wednesday between US President, King Abdullah and di Palestinian and Egyptians leaders.
Oga Biden don land Tel Aviv to show im kontri “solidarity wit Israel” and “ironclad commitment to dia security.”
End of Di one wey oda users dey read well well
Fotos wey commot from Al-Ahli Arab hospital on Tuesday night show scenes of destruction, wit bloodied and wounded casualties wey dem dey rush comot on stretchers in di darkness.
Di fotos show bodies and destroyed vehicles for street outside.
One video show as bomb hit di area and blast follow.
"We bin dey do operation for di hospital, one strong explosion occur and di ceiling fall on di operating room. Dis na massacre," Dr Ghassan Abu-Sittah, one Médecins Sans Frontières plastic surgeon wey dey help treat pipo wey injure for war tok.
Who be di Palestinian Islamic Jihad - and how e take dey different from Hamas?
Di Israeli military don blame last night hospital blast for Gaza on one misfired rocket from Palestinian Islamic Jihad.
Palestinian Islamic Jihad na di second biggest militant group for di Gaza Strip and dem get di support of Iran.
E get similar Islamist ideology to Hamas and dem also dey committed to di destruction of di state of Israel. Pipo usually dey see am like say dem dey more extreme pass Hamas.
Islamic Jihad dey operate independently from Hamas, but di bigger group dey usually show up wen dia actions dey required.
Islamic Jihad get dia own militant wing, di Al Quds Brigade, and dem get dia own rocket arsenal.
Israel release clip wey show say na militants cause di hospital blast
During one news conference by di Israel Defense Forces (IDF), one of di claims wey Israel make na say dem get clip of wia Palestinian militants dey discuss one failed rocket launch.
Dis, di Israeli military claim say na prove say na di Palestinian Islamic Jihad (PIJ) militant group cause di blast wey happun for Gaza Al Ahli hospital.
Di transcript of di conversation - wey Israel release – show as two pipo dey discuss di damage caused.
"Dem dey tok say e belong to PIJ," one pesin tok, di oda pesin reply say: "Na from us?"
Di original speaker continue: "Dem shoot am from di cemetery wey dey behind di hospital."
"What?!" di oda respond, dem come tell dem say: "Dem shoot am from di cemetery wey dey behind di hospital, and e misfire and fall on dem."
IDF tok-tok pesin Daniel Hagari tok say: "We don cross-check dis intercept wit oda intelligence sources to confam im accuracy."
But di BBC neva verify Israel version, including who dey tok for di clip.
Joe Biden land for Israel
Meanwhile, US President Biden don land Israel for one meeting wit Israeli Prime Minister Netanyahu.
Biden go discuss wit Netanyahu during di visit, but one planned meeting e suppose get wit Arab leaders – wey include Palestinian president Mahmoud Abbas – don cancel afta di blast on Gaza Al Ahli hospital on Tuesday night.