You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
18-year-old Briton wey bin get sex wit 17-year-old girl for Dubai begin jail sentence
One 18-year-old Briton wey dem convict sake of say im get sex wit one underage 17-year-old British girl for Dubai don begin im jail term for Al Awir prison, one charity tok.
Marcus Fakana wey come from Tottenham, north London, bin start a secretive romance for September wit anoda Londoner, wey don be 18 now, while both of dem bin dey on holiday wit dia families.
After returning home and seeing pictures and chats between di pair, di girl mama bin report di relationship to Dubai police, wey bin arrest Fakana for im hotel. Sex wit pesin under 18 dey illegal for Dubai.
Di Foreign, Commonwealth and Development Office say dem bin dey support one British man for di United Arab Emirates (UAE).
Fakana bin hand imsef to Dubai Al Awir prison, according to di UK-based campaign group and charity Detained in Dubai.
Im bin dey on bail and stay for temporary accommodation for Dubai since im arrest for September. Im parents gatz return to London to resume dia jobs for one warehouse and as cleaner to help pay for dia son accommodation.
'E dey veri brave'
Radha Stirling, chief executive of Detained in Dubai, wey dey help foreigners abroad and na international authority on UAE law, say she don speak wit Fakana, wey tell am say e go focus on im physical and mental health for jail.
"Marcus dey hopeful say as im begin im ordeal today, e go dey home sooner dan e go be if e appeal," she tok.
"E dey difficult to get di right words to tell a young man turning imsef in for a year in Dubai prison.
"E dey veri brave and kind and I truly hope e go dey home soon."
One charity dey support Fakana family. Di charity say di boy parents dey advocate for a royal pardon and a lesser sentence.
Dem also dey push di UK goment and Foreign Secretary David Lammy "for assistance".
Ealier dis month, a Downing Street tok-tok pesin say: "Di prime minister recognise say na extremely distressing situation for Marcus and im family."
Previously, di charity explain say both teenagers bin dey on holiday wit dia parents for di UAE from di UK, wia di age of consent na 16.
Fakana bin tell im family about di romance but di girl bin no tell her own parents.
Di goment of Dubai previously say: "Under UAE law, di girl dey legally classified as a minor and, in accordance wit procedures recognised internationally, her mother - being di legal guardian - bin file di complaint."
Dem add: "Dubai legal system dey committed to protect di rights of all individuals and ensure impartial judicial proceedings."