England confirm Tuchel as dia new manager

Wia dis foto come from, Getty Images
Thomas Tuchel appointment as England manager go start from 1 January 2025.
Di 51-year-old German go become di third non-British permanent manager of di men team afta Sven-Goran Eriksson and Fabio Capello.
Gareth Southgate bin resign for July afta Spain defeat England for Euro 2024 final.
Lee Carsley, wey bin collect appointment as interim manager for August, go remain in charge for di Nations League matches against Greece and di Republic of Ireland next month.
Under Carsley, England lose to Greece on 10 October and beat Finland on 13 October.
Tuchel, wey bin leave Bayern Munich at di end of last season, say: "I dey very proud for dis honour to lead di England team.
"I feel a personal connection to di game for dis kontri, and e don give me some incredible moments already.
"To get di chance to represent England na huge privilege, and di opportunity to work wit dis special and talented group of players dey very exciting."
Chief executive Mark Bullingham say di Football Association don appoint "one of di best coaches in di world".
English coach Anthony Barry go be Tuchel assistant.
Di Football Association say Tuchel na dia "preferred candidate" from di "oda candidates" wey dem interview.
Tuchel don manage Mainz, Borussia Dortmund, Paris St-Germain and Chelsea bifor im move to Bayern.
Im win German Cup wit Dortmund and two Ligue 1 titles for PSG, including a domestic treble for2019-20.
Im become Chelsea manager for January 2021, wia im win di Champions League, Club World Cup and Uefa Super Cup bifor im chop sack for September 2022.
Afta Bayern fail to win di Bundesliga title last season for di first time since 2011-12, im leave despite di fact say im bin still get one year to run on im contract.
Tori be say di FA board approve di decision last week and Tuchel signed di contract on 8 October.
"Dem delay di announcement to minimise distraction around di international camp wey just end," di statement read.
Who be Anthony Barry?
England get new manager in Thomas Tuchel and im new number two na Anthony Barry.
Dem born Barry for Liverpool, im playing career start Coventry and end wit Wrexham for 2017.
During dat time, im play for di likes of Accrington Stanley, Fleetwood and Chester.
England number two man na 38 years old.










